Saturday, July 21, 2012

NA COMPLAIN DEM DEY COMPLAIN





Dem go say dem no be kitchen properties
Say dem wan be political entities
Say God giv dem sef faculties
To take dey run tins for we communities
Even for we house
Dem go say dem no go wear blouse
Say like we, na two legs dem get
So na jeans and leggings dem in sets
Na complain dem dey complain

Dem go sit for house all day
Make up and nack tory all d way
Dem go dey fresh while we dey go grey
Even for action, na on top dem wan stay
For morning, dem go preach independence
Yet for evening, na “Honey, buy me benz
Buy me designers’ lens
Buy me intelligence; c’mon, don’t be denz”
Na complain dem dey complain

Dem say thirty percent for Beijing
Na the work of men wey drink gin
Say for here na fifty-fifty or notin
Or dem go dambaru evri even for coffin
Dem don dey harden their tones
Say dem go soon dey hit us like US drones
Say until we address their woes
Dem go block all their vital holes
Na complain dem dey complain






No comments:

Post a Comment